For a better Radio for Migrants streaming experience

News for Migrants
in Pidgin english

EPISODE One

By Adeshola and Giulio
2G Pressroom of Radio News for Migrants - Genova

EPISODE 1

Make we welcome all our broda and sister wey comot from Naija…. Dis program wey you dey hear so na for our people wey de hear pidgin as we dey talk am for house and wey dey live inside Italy…

Na from our newsroom wey dey for Genoa for inside Liguria na him we dey bring una dis tori.

Anywhere wey you dey wey you dey pick our signal, make you dey hear us thru RADIO FOR MIGRANT inside www.radioformigrants.eu.

Today, we dey bring una tori as e dey hot from inside our newsroom wey dey Genoa.

De number ONE thing wey our people suppose know today na be sey the way wey our people to go collect visa for their FAMILY, their FRIENDS and even for STUDENTS don change kpata-kpata…. e don change….

 

Make we bring una the main tori wey de happen now….

Italian Consulate for Lagos don open two new Visa center wey dem call TLS…Na dem be de company wey go dey handle all de Italian Visa wey people dey request wen dem wan travel go Italy.

Make we give una de new Visa application centers wey dey for Lagos and Abuja….

Since the 24th of May wey we check, una fit apply for Italian visa for the the following Visa Application Center wen dem call VAC:

For Lagos, de address na: TLS contact- Visa Application Centre,
Fourth Floor, Ivie House, 4/6 Ajose Adeogun Street,
Victoria Island, Lagos, Nigeria.

For Abuja, de address na: TLS contact- Visa Application Centre
Third floor, El-Yakub Place,
Plot 1129, Zakaria Maimalari St, (beside Metro Plaza),
Central Business District, Abuja, Nigeria.

Una know sey over 700, 000 people dey for dis Italy wey no get health card…? and as dem no get health card so, government no gree give dem covid19 vaccine… dis na people wey dem call immigrants..dat one mean sey dem come from other countries wey dey outside Europe come settle for Italy.. some of dem get wetin dem call STP Card (Foreigners temporarily present)… Dat STP Card go allow Government to assist una wit different health care wey include Vaccines.

Dis explanation na from Health Director of IMP wey be (National Institute for Health, Migration and Poverty) na him break am down give ANSA and other people wey suppose know….

Another group for dis category na EU immigrants wey get ENI Card (dat one na people wey come from Europe but dem no dey registered)…

But with this only, you no go fit access health care if you not get tax code and health card code… for all the regions, na only Emilia Romagna dey accept de STP Card just like dat…

For some regions, you go need to get Digital Identity Code wey dem call SPID or the certified Mobile Number ooo.

For this level, foreigners wey no get health card or other codes wey I talk about, government to cut dem off from health care even if dem get right to vaccination.

With this kain data, people dey take am sey e go dey impossible to achieve wetin dem call HERD IMMUNITY ooo

Temporarily Present Foreigner Card wey dem dey call STP Card na de regional Identification code wey dem de give foreigners wey never get residence permit for this country… Dem de issues am the first time wey such foriegner enter any public hospital…for example na region like Genoa.

Dis STP Card, na only 6 months you fit use am but you fit renew am after e expire for the 6th month…

STP card dey backed by Article 35, paragraph 3 for consolidated law of Immigrant… Dis card cover any urgent or essential health case wey any body get… whether na continous ooo, outpatient or hospital treatment for person wey sick or na injury…dis STP cover am. Person fit use am for preventive health or to take safeguard himself and others wey dey under am.

Person sef fit use dis STP card for protection during pregnancy and maternity…Protection for children dem and even for vaccination too but under dis one,you go check the region wey you dey so you fit know if the region go accept de card make you for fit vaccinate yourself… De card go also cover International prophylaxis intervention… treatment for infectious disease and for remediation of outbreaks… even de intervention, prevention, treatment and rehabilitation of drug addiction dey under dis card too…

Everybody know sey Covid19 de spread quick-quick and e dey kill people fast-fast and e don affect live of plenty people across we world.

De European Journal of Public Health don talk how covid19 take affect people wey come from other countries wey dey for here…. Dem talk am sey for the 213,000 cases of covid19 for Italy, 15,000 people wey no be italians catch de sickness two weeks later… Dat come mean sey, dem no de detect the sickness for their body on time and when time reach to diagnose dem, de thing don enter dem body and dem don already de manifest symptoms…

But make we even ask wetin de cause dis kind delays sef…?

You know sey for Italy here, all foreign citizens fit get emergency health services for any clinic but the big wahala wey dey na the language difference…. most of these foreiners no de hear Italian and many Italians no dey speak English or dis foreigner’s language… so dem no de fit communicate to tell health worker how e de do dem for body… and when e happen like dat, e go come delay when dem suppose get help.

Dem don put Italy for the yellow category…. e no go tey before italy go enter white category… and to achieve white category wey mean sey Italy no dey ynder health threat again, make una de remember all the health restrictions wey concern personal safety… dat one include use of facemask, social distance and to de wash hands regularly with soap… make una no forget at all.

Very soon, we go give una infomate about where and how una fit get assistance for de documents wey we dey talk about…

My people, na wey tori end for now be dat ooo… we go come back again with more informat wey go help una for dis place wey una dey…

 

Una bye bye oooo.

Thanks to our team in Lagos: Director and translator Mike Okwuoche – TVC News